Galatasaray vs Man United highlights: Livescore as McTominay, Garnacho, Fernandes, Ziyech all score

29 November 2023
Manchester United go dey disappointed in dem sef afta dem blow dia lead three times for Champions League match wey dem need victory.
United neva win any game for di Group A wey dem dey – dem play 3-3 wit Galatasaray for Istanbul.
Di match wey get plenty highlights from balls wey hit bar to disallowed goal and fine save by di goalkeepers of both teams.
Na in-form Alejandro Gernacho open scoring for Unite for first half before Bruno Fernandez double am for dem.
E take Hakim Ziyech brilliant free kick at di edge of di box to give di host a lifeline.
United den score again for second half while Ziyech score again wit anoda free kick.
Substitute Kerem Akturkoglu finally score di equalizer for Galatasaray.
Second Half

Galatasaray 3-3 Man United
90+4mins: FULL TIME
90mins: 3 mins of added time
90mins: Facundo Pellistri quickly pick up a rebound and shoot but di goalkeeper make a fine save.
88mins: SUBSTITUTION. Wilfried Zaha comot for Kerem Demirbay
85mins: Bruno Fernandes shot from di edge of di box right onto di left post.
82mins: SUBSTITUTION. Hakim Ziyech comes Baris Alper Yilmaz. Angelino comot for Victor Nelsson
79mins: Facundo Pellistri get di ball and drive a shot high over di bar from di edge of di area.
78mins: SUBSTITUTION. Alejandro Garnacho make way for Facundo Pellistri. Diogo Dalot enta for Aaron Wan-Bissaka
76mins: CLOSE! Alejandro Garnacho fires shot from di edge of di box
Galatasaray 3-3 Man United
73mins: Anthony Martial find imself beyond di last defender but linesman raise flag for offside.
72mins: Sergio Oliveira shoot from di edge of di penalty area.
71mins: GOAL! Kerem Akturkoglu make am 3:3
68mins: Hakim Ziyech almost convert goal for di edge of di box
68mins: Hakim Ziyech almost convert goal for di edge of di box
Galatasaray 2-3 Man United
64mins: YELLOW CARD for Aaron Wan-Bissaka
62mins: GOAL? Hakim Ziyech score again
60mins: SUBSTITUTION. Tanguy Ndombele comot for Sergio Oliveira. Dries Mertens comot for Kerem Akturkoglu
59mins: YELLOW CARD for Luke Shaw
58mins: SUBSTITUTION. Kobbie Mainoo replaces Sofyan Amrabat. Anthony Martial enta for Rasmus Hojlund
55mins: GOAL! Scott McTominay make am 3 for United
54mins: YELLOW CARD for Kaan Ayhan
52mins: Hakim Ziyech take di corner and send an into di penalty area
50mins: Luke Shaw attempt to find Rasmus Hojlund, but pass di ball far too much
48mins: Kaan Ayhan come close to scoring but di ball just scratch di side of di net
Galatasaray 1-2 Man United
45mins: Second Half don start
First Half

Galatasaray 1-2 Man United
45+2mins: Referee blow im whistle for half-time
45mins: 2mins of added time.
43mins: DISALLOWED GOAL! Ref catch Mauro Icardi offside.
42mins: YELLOW CARD for Sacha Boey for bad challenge on im opponent
40mins: Angelino trip opposition player and Jose Maria Sanchez signal foul. Free kick to Manchester Utd.
38mins: Scott McTominay jump pass di defender and head di ball to score but e go wide.
37mins: Bruno Fernandes swing in a dangerous cross from a resulting corner kick, but none of im teammates manage to outjump di defence.
35mins: United don escape dis one. Wilfried Zaha try effort from inside di box but Maguire block am.
32mins: Hakim Ziyech strike again from di edge of di box, but e no hit am well
Galatasaray 1-2 Man United
29mins: GOAL! Hakim Ziyech strike wit a perfectly taken free kick
27mins: YELLOW CARD for Bruno Fernandes
24mins: Abdulkerim Bardakci send a long ball forward to Dries Mertens, but e put too much power and di chance don
Galatasaray 0-2 Man United
18mins: GOAL! Luke Shaw find Bruno Fernandes on di edge of di box and e fire di ball into di top left corner.
15mins: Lucas Torreira jump inside di box to meet di corner and aim a header towards di right post, but di goalkeeper pull off astonishing save to deny am.
Galatasaray 0-1 Man United
11mins: GOAL! Bruno Fernandes produce a great pass wey find Alejandro Garnacho inside di penalty area
11mins: Kaan Ayhan send long cross over to Wilfried Zaha, but Andre Onana come forward to gather the ball.
8mins: Bruno Fernandes lose di ball afta e receive sweet pass from Antony
4mins: Dries Mertens try im luck wit a long-range effort afta receiving a precise pass. E go to di bottom right corner.
2mins: A crossfield pass from Abdulkerim Bardakci fail to find any of im teammates. Di referee and the linesman both signal a throw-in for Manchester Utd.
Galatasaray 0-0 Man United
1min: KICK OFF

Line-up for di game
Machester United line up
Onana, Lindelof, Amrabat, Maguire, Fernandes, Hojlund, Garnacho, Antony, Shaw, Wan-Bissaka, McTominay
Galatasaray team news
Mustera, Boey, Abdulkerim, Kaan, Angelino, Ndombele, Torreira, Ziyech, Mertens, Zaha, Icardi
Last year, dis team for Barcelona [for Europa League do well], so we know how to deal with dis kain tin and I dey sure say na confident team go dey pitch," Ten Hag add.
Bayern Munich don reach di Champions League knockout stage as Group A winners wit two matches to spare afta dem beat Galatasaray.
But Manchester United, FC Copenhagen and Galatasaray all of dem still fit reach di last 16.
But United, go comot if dem lose to Galatasaray on Wednesday.
And even den sef, di Red Devils' fate no dey dia own hands - dia two wins from dia final two matches no go dey enough for Erik ten Hag side if FC Copenhagen also win dia two games too.
Galatasaray vs Man United predictions

‘’Dis Champions league game go dey highly-charged sake of all di intimidation fron di home fans’’. Football sabi pesin Joshua Adetunji tok.
‘’Manchester United dey go very difficult ground, di Rams Global stadium, wey be Galatasaray home ground’’. Adetunji add.
‘’Galatasaray dey a good place to qualify afta dem win di reverse fixture 3-2 for Old Trafford and United know say dem no go fit reach di knockout phase if dem lose tonight for Turkey’’.
‘’I believe say di game go end for draw’’.
Prediction- 2-2
Galatasaray vs Man United possible line up
Galatasaray: Muslera; Boey, Ayhan, Bardakçı, Angelinho; Torreira, N'Dombélé; Barış Yılmaz, Mertens, Zaha; Mauro Icardi
Players wey no go play sake of injury: Sánchez
Player wey fit no play: none
Players wey go miss next match if dem collect card: Sérgio Oliveira
Man United: Onana; Wan-Bissaka, Lindelöf, Maguire, Shaw; Mainoo, McTominay; Pellistri, Bruno Fernandes, Garnacho; Martial
Players wey no go play sake of injury: Martínez, Casemiro, Eriksen, Mount, Evans, Malacia
Player wey fit no play: Højlund, Antony
Suspension: Rashford
Di game go start 6:45pm west African time.
ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomrNxYmyBdLDGbHCo